N5,000 Monthly Allawe For di 2m Nigerians To Start June – FG

0

Federal gofment don announce say two million Nigerians go soon start to dey collect five-five thousand Naira from June as basic cash transfer under di National Cash Transfer Programme.

Di Federal Gofment go dey pay N5,000 each from inside N20 billion wey dem been budget to give
beneficiaries, especially poor pipul wey no get anything.

For inside di March document on di strategic roadmap and activity of di Federal Ministry of Humanitarian Affairs, Disaster Management and Social Development, di document tok say di number of beneficiaries don dey increase.

Di document follow tok say for 2018, about 19 state na im dem cover for dis National Cash Transfer Programme, and e come increase to 24 state in 2019, come follow increase again to 36 states and di Federal Capital Territory in 2022. Altogether, na 1.6 million pipul dey benefit.

Even sef, di Minister of Humanitarian Affairs, Disaster Management and Social Development, Sadiya Farouq tok say di document show say di number go still increase in June.

“School retention, good water and hygiene conditions for deir house and environment,”
Madam Farouq tok say her ministry na im designed wetin dem dey call ‘social register’ wey dem call am Rapid Response Register to use record poor workers wey be say na daily wage dem dey collect for their petty work. Dem find all dis pipul for different-different town and city, especially di ones wey really suffer during di COVID-19 lockdown.
“Up till now, out of di one million beneficiaries wey di gofment been target, we don pay N5,000
to 850,000 beneficiaries digitally through di Nigeria Inter-bank Settlement System wey dey validated all di account before payment.

“We go pay 150,000 by di end of April. All dis beneficiaries go collect six months of support in cash.”

Di ministry tok say according to dis National Social Register, 46 million pipul for all di 36 states and the FCT, gada from about 11 million household na im dem don registere as of 2022.

E come follow tok say di N-Power volunteer scheme don provide temporary job opportunity for 498,602 graduate for inside Batch A and B while 450,000 graduate under Batch C,
Stream 1 don dey engaged.
Di ministry come tok say dem don dey gather anoda 390,000 pipul for Batch C Stream 2 and say dem don get presidential approval to add another 1 million beneficiaries.

FG DON ENGAGE 98,000 BENEFICIARIES FOR GEEP 2.0 PROGRAMME

0

Di Ministry of Humanitarian Affairs, Disaster Management and Social Development don concluded plans to roll out di Gofment Enterprise and Empowerment Programme GEEP 2.0 for all di 36 states and the Federal Capital Territory.
Dis na afta di final verification of Phase 1 applicants wey been qualify wey dem select to benefit from small loans ranging from N50,000 to N300,000.

Di Minister Sadiya Umar Farouq tok say all beneficiaries of GEEP 2.0 go collect congratulation and sensitization text message wey go also tell dem say dem don qualify and di message go also sound am well-well say dis empowerment program na loan, no be grant.

“All di beneficiaries wey qualify go soon receive their disbursement alert. We wan also remind all di beneficiaries wey qualify say this na loan wey una go fit pay back without interest. No be grant or free money from gofment oh. Na soft interest-free loan wey una must pay back 9 months”.

Minister Umar Farouq come also announce say di Ministry dey plan rollout di program all around di country, na afta dis part na im dem go start the biodata part.

Dis GEEP 2.0 na loan scheme wey di Federal Gofment design to provide moni and finances wey go fit go round to many poor pipul as well as pipul wey get disability and oda grassroot pipul wey dey really struggle, di scheme dey under dis three main di main schemes: Market Moni, Trader Moni and Farmer Moni.

Trader moni na for youth of between 18-40 years wey no get any means of survival like under-privileged and marginalized youths. Dis scheme go provide loans of N50,000 while Market Moni dey take under-privileged and marginalized women between 18-55 years like Widows, divorcees amongst other vulnerable groups. They get interest-free loans of N50,000 payable within 6-9 months.

Farmer Moni na for Nigerian farmers wit age between 18-55 years wey dey for rural area wey dey operate in di agricultural space. Dem go provide beneficiaries with loans of up to N300,000 for farming input. Dis scheme get 12 months including 3 months moratorium and 9 months repayment period.

NNEKA IKEM ANIBEZE
SA MEDIA
06-04-2023

Abuja-Kaduna Train Attack: Humanitarian Minister come dey pity Wit d Victims

0

Di Minister of Humanitarian Affairs, Disaster Management and Social Development Sadiya Umar Farouq don send im condolence message to all di family and victim of di Abuja-Kaduna train wey unknown gunmen attack on Monday for Dutse Forest, Chikun Local Government Area of Kaduna State.

Di Minister, been directed sharp-sharp deployment of di NEMA Northwest Zonal Office team to go di place wey di train attack been hapun and to check on di victims; she tok say dis incident dey very horrific.

“I dey send my heartfelt condolences to di family of di pipul wey lose dier lives for dis attack. I pray say God go console and strengthen dem at dis time of grief. I de also pray for di wounded and hospitalized pesins wey sustain injuries, I pray say dem go recover quick-quick”.

Di National Emergency Management Agency Zonal Coordinator Abbani Imam Garki na im lead im team go visit eleven victims wey dey receive treatment for St. Gerald’s Hospital for Kaduna. Dem refer eight victims to 44 Nigerian Army Reference Hospital, Kaduna. Anoda two of di victims wey sustain gunshot wound and fracture still dey hospitalized.
Di management of di hospital follow confam dem get twenty-five (25) victims on admission wey gada get different-different injury.

One representative of di Chief Medical Officer of the 44 NARHK
hospital tok say some victims don already do surgery, while oda victims don collect treatment come dey under observation.

Kaduna State Emergency Management Agency don announce say make family of di victims try contact 09088923398 for inquiries or to provide information on passengers wey travel with di Abuja-Kaduna train on March 28, 2022.

𝘚𝘰𝘤𝘪𝘢𝘭 𝘗𝘭𝘶𝘴 𝘈𝘧𝘳𝘪𝘤𝘢 𝘗𝘪𝘥𝘨𝘪𝘯

𝘛𝘳𝘢𝘯𝘴𝘭𝘢𝘵𝘪𝘰𝘯 𝘣𝘺 𝘔𝘢𝘺𝘮𝘶𝘯𝘢𝘩 𝘡𝘶𝘣𝘢𝘪𝘳

𝗞𝗢𝗚𝗜 𝗛𝗢𝗨𝗦𝗘 𝗢𝗙 𝗥𝗘𝗣𝗦 𝗔𝗦𝗣𝗜𝗥𝗔𝗡𝗧 𝗔𝗟𝗛. 𝗪𝗔𝗦𝗜𝗨 𝗜𝗦𝗦𝗔𝗛 𝗖𝗢𝗠𝗠𝗘𝗡𝗗𝗦 𝗚𝗢𝗩𝗘𝗥𝗡𝗢𝗥 𝗕𝗘𝗟𝗟𝗢, 𝗔𝗣𝗖 𝗖𝗛𝗜𝗘𝗙𝗧𝗔𝗜𝗡𝗦 𝗙𝗢𝗥 𝗦𝗨𝗖𝗖𝗘𝗦𝗦𝗙𝗨𝗟 𝗖𝗢𝗡𝗩𝗘𝗡𝗧𝗜𝗢𝗡

0

The Convener of Wasiu Issah Network (WIN) and House of Representatives aspirant for the Okehi/Adavi Constituency of Kogi State, Alh. Abdulwasiu Issah has commended Governor Yahaya Bello for a successful outing at the APC National Convention which held yesterday.

Alhaji Wasiu felicitated with the newly elected party officials as well, calling the entire process an exercise in true democracy. He noted that this was a testament to the party’s unity and sense of purpose. He opined that this and many more orderly electoral processes is what citizens should expect during the general election, come 2023.

In his remarks to press reps, Wasiu stated that he was most impressed with the orderliness and peaceful proceedings of all that were in attendance; instances of chaos or conflict were immediately quelled. This, he attributed to the dogged determination of Kogi State’s Governor Yahaya Bello, who served as the chairman of the security subcommittee.

“I must commend and congratulate His Excellency, Governor Yahaya Bello for a successful and peaceful convention today. Indeed he went over and beyond to see that all security apparatus were deployed to ensure a favorable and peaceful atmosphere for party stalwarts and supporters alike. This is not surprising, as His Excellency has consistently kept the peace and won numerous accolades as the most security conscious Governor in the country. This, more than anything, cements the numerous reasons why he should take on the mantle of President, come 2023,” he said.

Speaking further, the aspirant urged the incoming party officials to toe the line of their predecessors and avoid skirmishes and rancour within the party in order to keep a united APC. He appreciated President Muhammadu Buhari, as well as the prevailing of other elders in the party for keeping the peace up till this moment, and charged party leadership and officials to work in tandem to deliver on the mandate of the party in the coming election.

Signed,
Wasiu Issah Network (WIN)
Media and Publicity

FG DON APPROVE TRAINING OF 50,000 NON- GRADUATE N-POWER BENEFICIARIES

0

Di Federal Gofment don approve di engagement of four of im Agencies to train 50,000 Non-Graduate N-Power Beneficiaries.

Na for di Federal Executive Council wey hold on Wednesday, na im dem approve say make di National Institute of Transport Technology NITT, Industrial Training Fund ITF, National Institute for Hospitality and Tourism, Hydraulic Equipment Development Institute HEDI train di beneficiaries for 9 months.

Di Minister of Humanitarian Affairs, Disaster Management and Social Development Sadiya Umar Farouq tok say di ministry dey run di implementation of di National Social Investment Programme (NSIP) in line with im mandate to reduce poverty, and to increase social inclusion and youth empowerment.

“Dis N-Build dey under di N-Power cluster of programmes wey NSIP dey manage and e dey target unemployed non-graduates. Dis proposed training na continuation of N-Build training wey start in 2017 wit all di batch of N-Power trainees.

“Di Ministry don review di delivery process of di N-Build programme so dat we go fit confirm whether e dey helep wit di Job Creation/Poverty Reduction agenda of di Federal Gofment and note di capacity of the four existing professional vocational training Institutes wey di gofment set up with different mandates. Dem use care to choose dis Institutes in line wit di objective of di N-Power and e dey based on di capacity to train, assess, certify and guide candidates so dat dem go fit achieve di National Skills Qualifications (NSQs) of di N-Build Programme”.

The proposed training programme go be three (3)months of In-centre class training, six (6) months for apprenticeship, post Apprenticeship, mentorship with provision of Starter Packs and assessment wey go lead to di award of National Board for Technical Education (NBTE) Certification.

Di N-Build apprenticeship programme go dey coordinate across di 36 States and FCT and centres in almost 350 Local Gofment Areas.

Di National Institute for Hospitality and Tourism go provide professional and technical skills upgrade training programmes for di beneficiaries in Baking, Cooking/ catering, House- keeping and Mixology plus including all areas of Hospitality and Tourism, whether na directly or indirect aspect of hospitality, den, di Industrial Training Fund ITF go train beneficiaries in Electrical, Masonry, Plumbing and Carpentry.

Na di National Institute of Transport Technology NITT go handle di Training Services in Automobile and Agritech Tracks, while di Hydraulic Equipment Development Institute HEDI go empower beneficiaries in welding and Fabrication, Electrical Fittings and Plumbing.

SA MEDIA

24-03-2022

HUMANITARIAN MINISTRY DON LAUNCH NATIONAL POLICY ON IDP -COME HOST MEDIA PIPUL FOR HUMANITARIAN OPEN HOUSE

0

Di National Policy on Internally Displaced Persons IDP been launch on Tuesday by di Minister of Humanitarian Affairs, Disaster Management and Social DEVELOPMENT, Sadiya Umar Farouq.
Di policy document, wey dey approve by di Federal Executive Council (FEC) in September 2021 been launch for Abuja during di Ministry Humanitarian Open House, wey di theme na ”Coordinating for Durable Humanitarian Solutions; the Journey so far.’’

Di Minister tok say dem reason many-many factors for di humanitarian space for Nigeria before dem develop and adopt di policy.

“Di aim of dis policy na to provide framework for national responsibility so that we go fit prevent and protect not only citizens, but even non-citizens, from incident of internal displacement, to give dem assistance and protection as di displacement dey happen, and to ensure say dem dey rehabilitated for return, reintegration, and relocation afta di displacement. Di policy come follow mention all di principles wey dey guide humanitarian assistance and all di solution of internal displacement in Nigeria, and e don also adopt everything wey dey in line with human rights.

Di Minister follow tok say plans dey go on to domesticate di African Union Kampala Convention.

“I wan officially announce say we don start di standalone process to domesticate di African Union Kampala Convention. Make all di relevant oga-madam for dis matter come up with di draft bill for onward presentation to di FEC for approval with follow up transmission to di National Assembly for necessary legislative action.

To make sure say di policy dey efficient and effective as dem dey run am, Di minister don inaugurate di National Coordination Working Committee and she don tell di group and all oda important oga-madam to immediately start to dey run di plan, make dem also show di duty of all di pipul wey go dey part of di plan including monitoring and evaluation strategy, say make dem ensure say everything dey in line with policy framework and scope, and make dem also determine di extent of whether dem don achieve all di goals of di Committee and di policy.

Di Minister tok say di aim of di launch of di Humanitarian Open House na to showcase di activity and work of the ministry for di past two and half years.

“We set today as di day wey Ministry go take engage with di media, and all di oga-madam wey be partners so that dem go fit ask question, and give useful suggestions. Dis Open House na to encourage plenty-plenty talk and ideas wey go helep media pipul to fit dey give true-true informate to country pipul.

Minister Umar Farouq come present di Information Brochure and di National Social Investment Programme (NSIP) Information brochure to di public.

The brochure na book wey contain all informate about di Ministry, and all im Department, Programme and Agency. Dem come also comot photo album wey all di work and achievement of di Ministry dey inside. Di Minister come carry di guests round di Humanitarian Pavilions.

Oda Oga-madam wey tok for di program include Speaker, Nigeria’s House of Representatives Femi Gbajabiamila, wey dey represented by Hon Muhammad Jega, wey be Permanent Secretary of di ministry, Bashir Nura Alkali wey dey represented by Director Humanitarian Affairs, Alhaji Ali Grema and di UN Resident Coordinator Matthias Schmale. Him sef pledged to continue to dey support di Ministry concerning IDPs.

Oda pipul wey attend di program include Head of Agencies wey dey under di Ministry, CSOs/NGOs, Head of all di NSIP Cluster, Directors for di ministry, Strategic Partners, Editors and Humanitarian Affairs correspondents.

NNEKA IKEM ANIBEZE
SA MEDIA
22-03-2022

NIGERIA’s PANTAMI ADVOCATES FOR A SECURE AFRICA CYBERSPACE AT GISEC 2022

0

Nigeria’s Minister of Communications and Digital Economy, Professor Isa Ali Ibrahim Pantami has called on African governments to ensure the safety and security of the continent’s cyberspace through actionable policies, strategies and initiatives that support and drive cybersecurity.

Professor Pantami made the call today, 23rd March 2022 while delivering the opening address at the Global Africa Forum of the Gulf Information Security Expo and Conference (GISEC), holding at the World Trade Centre Dubai. In his detailed presentation, the Minister who quoted copiously from his book; CYBERSECURITY INITIATIVES FOR SECURING A COUNTRY, emphasised the need for a deliberate and inclusive plan centred around developing a National Digital Economy Policy to serve as the overarching policy for issues relating to cybersecurity, conducting a baseline study to identify the main cyber threats and the key elements of the cybersecurity ecosystem and developing a National cybersecurity policy or law. He also talked about enhancing and protecting critical ICT national infrastructure, capacity building, establishing a national cybersecurity centre to include a shield to scan and provide  a safety score for government and critical websites, and the enhancement of data protection and privacy, among others.

The Minister who further harped on the importance of digital identity as an enabler for cybersecurity as acknowledged globally said “the international community through the agreement of target 16.9 of the Sustainable Development Goals, calls for all UN member states to provide legal identity for all including birth registration by the year 2030. This is in recognition of the role of digital identity systems in supporting multiple development goals”.

The Minister, who oversees the largest digital economy in Africa, illustrated the strategies to a secure continental cyberspace using Nigeria as an example as most of the strategies outlined have already been adopted or are in full effect in the country. As a Professor of cybersecurity with the Federal University of Technology Owerri, (FUTO), the Minister also discussed the importance of the government-industry-academia triple helix model for promoting cybersecurity in Africa.

In attendance were Osai Bonsu Dickson, Chief Legal Adviser, Ministry of National Security Ghana, Ishaaq Jacobs Chief Cybersecurity Officer, South Africa, Kashif Inuwa Abdullahi, Director General of Nigeria’s Information Technology and Development Agency, Engr Abdulaziz Aliyu, Director General of the nation’s Identity Management Commission and cybersecurity experts from Africa, Asia and the Middle East.

Uwa Suleiman (Mrs)
Spokesperson to the Honourable Minister of
Communications and Digital Economy
23rd March 2022

WFP-FMHADMSD-ECOWAS JOINT TORI COMOT

0

17 March 2022

NIGERIA, ECOWAS SUPPORT WFP’s FOOD AND NUTRITION ASSISTANCE TO VULNERABLE FAMILIES WIT IM US$1M IN 2021

ABUJA – Di United Nations World Food Programme (WFP) don get di US$1 million moni in 2021 from di Gofment of Nigeria as part of ECOWAS humanitarian assistance to di Nigerian Gofment for d pupul wey d cata-cata bege for di wahala wey dey happun for North West and North East Nigeria.

Di moni from ECOWAS been dey granted to the gofment of Nigeria from di ECOWAS Regional Stabilization Fund. Di Gofment of Nigeria come join with WFP in Nigeria to use di moni take comot hungeri for Katsina, Zamfara and Borno states.

Di programme been dey target 840 households (some 4,196 persons) for Zamfara, Katsina and Borno states wey get food wahala, we go dey helep dem with food. Di beneficiaries go dey collect average cash transfer of NGN 27,000 in dier prepaid bank cards or WFP SCOPE cards every month to take buy food wey dem like from local market. Dem encourage beneficiaries to buy different-different local food from market. Dis cash transfer come get additional advantage of stimulating local markets as well as agricultural production.

To prevent serious malnutrition in children for di first 1,000 days of dem life, di programme come follow provide nutrition to dey helep children from 6-23 months old and to pregnant women as well as women wey dey breastfeed vulnerable and food wahala households. Some 14,070 children and 1,932 pregnant/breastfeeding women come get specialized nutritious food for di three (3) project states.

In addition to all dis, WFP dey use di ECOWAS donation to helep household wey dey for kata-kata wahala states of Borno, Adamawa, Yobe and Katsina tanda gidigba. Di project go also provide milling machines as well as training support to 603 returnees from Cameroon and displaced rural women to support dem to generate some income to take sustain dem livelihoods.

Quotes

Honorable Minister Sadiya Farouq, Federal Ministry of Humanitarian Affairs, Disaster Management and Social Development:

“Dis project don provide di FMHADMSD better-better way to dey showcase im best practice of partnership and collaborate in how dem dey take deliver humanitarian intervention. E don follow advance di effort of di Nigerian Gofment to touch di life of plenti-plenti Nigerians wey dey vulnerable situations.”

ECOWAS: Dr. Siga Fatima Jagne, Commissioner for Social Affairs and Gender, ECOWAS Commission:

“In line with di humanitarian mandate of di ECOWAS Commission also with di response to di Decision of di Fiftieth Ordinary Session of di Authority of Heads of State and Gofment of December 17, 2016, to assist population in North East Nigeria wey dey affected by terrorism, di ECOWAS Commission gather join with Gofment of Nigeria and di World Food Programme dey provide humanitarian support to our population for Nigeria wey dey in need, and e go continue to build di resilience of our people to bridge di gap wey dey between humanitarian work and development across di West African region for a prosperous ECOWAS Community.”

WFP:
Ronald Sibanda, WFP Representative and Country Director a.i.:

“Di contribution of Gofment of Nigeria, through ECOWAS, been come at a very critical point as country people dey suffer impact of wahala and climate change wey dey contribute to hunger for di country. Inside dis affected states, plenty wahala, climate shocks, high food prices don really undermine people’s ability to feed them sef. WFP really dey happi for dis contribution wey dey support di effort to continue to dey provide life-saving food and nutrition as well as assistance to people wey dey in need for states wahala of im states”.

Di United Nations World Food Programme na im be di ogbonge humanitarian organization for dis world wey dey save lives incase of emergency, and e dey also give food assistance. All dis things na im dey build road to peace, stability and prosperity for im country people wey dey recover from wahala, disaster, and di impact of climate change. Follow dem for Instagram @fmhds_ng and @worldfoodprogramme.

For informate, abeg call im
Halima Oyelade, FMHADMSD/ Abuja. Mob. +234 806 33 90 420. hoyelade@gmail.com
Godfrey Alozie, ECOWAS, Abuja. Mob. +234 803 701 1515. galozie@ecowas.int
Kelechi Onyemaobi, WFP/ Abuja. Mob. +234 902 486 7649. kelechi.onyemaobi@wfp.org

𝗠.𝗝 𝗢𝗭𝗢𝗩𝗘𝗛𝗘 𝗕𝗜𝗥𝗧𝗛𝗗𝗔𝗬: “𝗪𝗜𝗡” 𝗖𝗢𝗡𝗩𝗘𝗡𝗘𝗥 𝗙𝗘𝗟𝗜𝗖𝗜𝗧𝗔𝗧𝗘𝗦, 𝗖𝗔𝗟𝗟𝗦 𝗛𝗜𝗠 𝗜𝗖𝗢𝗡.

0

The founder of Wasiu Issah Network, Hon. Abdulwasiu Issah has wished elder statesman and one time Executive Chairman of Okehi Local Government Area of Kogi State, M.J Ozovehe a happy birthday.

In an open message made available by his press rep, Issah calls the celebrant an icon of his time filled with wisdom and and a sense of duty.

He praised his steadfastness to the people of Kogi State and extolled his virtue as an astute politician while praying God’s blessings upon him.

“We appreciate all your efforts, wisdom, and commitment to the fulfilment of a united Okehi, as well as unity in Kogi State,” he said.

FG DON KICK-START EM NEXIT CBN AGRIC BUSINESS INVESTMENT SCHEME FOR OVER 460,000 EXITED N-POWER BENEFICIARIES DEM

0

Di Minister of Humanitarian Affairs, Disaster Management and Social Development, Sadiya Umar Farouq don Don kick-start di NEXIT/CBN Agri-Business Small and Medium Enterprises Investment Scheme N-Power beneficiaries dem Batches A and B wey dem don dey wait so tey.

Out of di 467,183 trainees wey show interest, 75,600 na im go participate for di first phase of di orientation programme wey dey expected to lead to collection of loans wey go reach up to three million Naira from Central Bank of Nigeria if dem qualify.

For di kick-start ceremony wey happen on Monday for Press Centre, Radio House Abuja, di Minister, wey dey represented by di Permanent Secretary Bashir Nura Alkali thank President Muhammadu Buhari for dis administration and all im efforts to comot poverty from di country and for di constant support and sustainance of di National Social Investment Programmes.

She also congratulate di 467,183 trainees wey show interest for di NEXIT CBN AGSMEIS programme from di 500,000 dem batch A and B exited im beneficiaries.

Umar Farouq tok say dis na di first of plenty-plenty other phases wey go take place in all di 36 states and FCT.

“Na my greatest desire to see say di exited batches A and B N-Power graduate beneficiaries go dey attended to for different channels, I don dey assure dis plenty youths say di Ministry of Humanitarian Affairs, Disaster Management and Social Development dey work very close wit Central Bank of Nigeria to realize dis dream.

“Today go mark di begin of di fulfilment of dis training wey we don dey wait, wey go enable di beneficiaries wey show interest to participate for di CBN empowerment programme.

“To make sure say everything go coole, we go conduct dis training programme in phases. Make I also tell una say all di 36 States and FCT go participate for dis so tey NEXIT training programme wen we dey wait for to come. Total of 75,600 participants dey for dis dem first batch of the training. We go continue to dey train di remaining batch as soon as em possible

“Di Federal Ministry of Humanitarian Affairs, Disaster Management and Social Development dey very committed to make sure say we gather all di objective and plan of all di social intervention programmes sake of make we achieve di goals and objectives.

“​Di N-Power programme na ogbonge part of di National Social Investment Programme wey dey under di Federal Ministry of Humanitarian Affairs, Disaster Management and Social Development, wen dem design to achieve di National objectives of reduction of poverty and creation of job. Di N-Power programme dey important in area to help young Nigerians to get and develop skills wey go follow dem for life, and wey go ensure say dem sef go become solution providers and entrepreneurs for deir community”.

For him welcome address, di Permanent Secretary wey dey represented by di Director Planning, Research and Statistics Raphael Oraeluno tell di beneficiaries say make dem make use of dis opportunity well-well.

“I want make every trainee see dis unique opportunity as blessing wey dem must no waste. I remember how we take waka come reach dis point wey we dey so. Now wey una don finally get dis opportunity, make sure say una maintain di highest level of seriousness throughout di training programme and afterwards. As beneficiary, una go dey very equipped with di necessary training wey go guarantee say you go fit participate in the CBN package wey dey meant for dis purpose”.

Di National Coordinator, National Social Investment Programmes Dr Umar Bindir follow advise di beneficiaries to take advantage of di CBN package to be self sufficient.

At di end of the five day training, beneficiaries wey qualify go collect loan reach three million Naira with maximum tenure of seven years.

NNEKA IKEM ANIBEZE
SA MEDIA
14-03-2022