𝗛𝗨𝗠𝗔𝗡𝗜𝗧𝗔𝗥𝗜𝗔𝗡 𝗠𝗜𝗡𝗜𝗦𝗧𝗥𝗬 𝗥𝗢𝗔𝗗𝗠𝗔𝗣 𝗗𝗘𝗬 𝗖𝗢𝗡𝗦𝗜𝗦𝗧𝗘𝗡𝗧 𝗪𝗜𝗧 𝗡𝗔𝗧𝗜𝗢𝗡𝗔𝗟 𝗗𝗘𝗩𝗘𝗟𝗢𝗣𝗠𝗘𝗡𝗧 𝗣𝗟𝗔𝗡 -𝗢𝗦𝗜𝗡𝗕𝗔𝗝𝗢

0
923
Share the Story

𝗣𝗥𝗘𝗦𝗦 𝗥𝗘𝗟𝗘𝗔𝗦𝗘

Di Federal Gofment don tok say di Strategic Roadmap of di Federal Ministry of Humanitarian Affairs, Disaster Management and Social Development dey in line wit di National Development Plan.

Na for di launch of di Strategic Roadmap of di Federal Ministry of Humanitarian Affairs, Disaster Management and Social Development, na im His Excellency, di Vice President Prof Yemi Osinbajo, tok am today for State House. Him tok say na dis roadmap na im di ministry go use take contribute to all d good-good tings wey gofment dey do.

For inside press release wey Deputy Director of Information, Rhoda Ishaku Iliya tok say di event wey be di launch of the Roadmap, His Excellency wey dey represented by di Deputy Chief of Staff to di President, Mr. Adeola Rahman Ipaye tok say “d Roadmap na im go stamp d important of joining hand wey di Federal, State, and Local gofments dey do, dis cooperation dey part of wetin go bring real transformate for we people”.

Him tok say, “we dey see say dis Roadmap go follow all di oda plan and program wey gofment don put for ground, and im go dey effective sake of say we go make sure say we put all we effort, untop di support wey Federal Gofment don alreadi dey support us from begining reach ending.”

Him come tell all stakeholders wey follow attend say make dem gather together to cooperate wit di Ministry sake of make Nigeria dey socially secure.

Untop all dis, “di Honourable Minister of Humanitarian Affairs, Disaster Management and Social Development, Sadiya Umar Farouq been tok say, “in order for make d ministry go take do im work wey President send am wella, dem don gather tink, come create dis strategic Roadmap for 2021 – 2025 wey go serve as guiding light to use see road to fulfil the work.”

According to madam, “dis Strategic Roadmap wey dem name, “𝗺𝗮𝗽𝗽𝗶𝗻𝗴 𝗼𝘂𝘁 𝗮 𝗹𝗶𝗳𝗲 𝗼𝗳 𝗱𝗶𝗴𝗻𝗶𝘁𝘆 𝗳𝗼𝗿 𝗮𝗹𝗹”, dey in line with di ogbonge work wey di Ministry get to carry di responsibility wey dey important to di economy of we countri, and well-being of we countri pipul. Di Ministry dey gallant to deal with issues, including natural palaver and palaver wey man cause, also to porvide chop, and equal-equal sharing of social amenities wey gofment provide, make e reach all our countriman dem.”

She continu di tok say “as we formulate di 7 (seven) agenda for di Strategic Roadmap, we look di 9 (nine) critical area of President Buhari agenda, as well as di Economic Recovery and Growth Plan (ERGP), and di National Development Plan wey Oga President launch on Wednesday, 22nd December last year, we try to do alignment of di Ministry strategic pillars with dis national plans so dat all go gather dey work for di same direction wey go bring growth and development wey go fit sustain.

  1. Di roadmap also follow join implement, monitor, evaluate, review and report of all di engine wey we go fire so dat good-good result go show clear-clear. Na all dis tings we go take measure our performate over di five-year period 2021 – 2025. Untop dis, the full implement of di roadmap, plus including federal gofment plans, na im we go use improve Di life of pipul wey dey suffer for di country.
  2. Di 7 (seven) point agenda wey Ministry put head for now include

a. To make all di policies and foundation of do ministry tanda gidigba;
b. To build System wey go dey transparent to di pipul;
c. To dey monitor all di program effectively;
d. To dey find opportunity for money to take implement all dis project;
e. To dey find partners to cooperate wit, and to dey include pipul wey get disability;
f. To implement system wey go add untop the humanitarian service wey di Ministry don alreadi dey provide, and to improve communicate between ministry and dj pipul; and,
g. To put all d Sustainable Development Goals wey don alreadi dey ground for front, come dey push am with all dis strategem dem.

“We don provide informate on all of the strategic pillars one by one – we come follow highlight all di action plans, and identify di important oga-madam dem wey dey di sector. Di roadmap sef don show all di activities wey we go do in different steps. We don also gather di stakeholders into groups and all deir work don dey inside di map.

“We dey expect say after dis launching, everyting wey we don dey do go align. All our department and unit go follow join dis new direction wey we dey go so. We go dey review our progress every three-three months to see how far we don go, and wetin remain to each our goal.”

Di Minister tok say dis Strategic Roadmap na di product of plenti-plenti tok and discuss with ogas and madams wey be oga pata-pata for inside and outside di ministry, and all di oda pikin agencies wey di ministry dey control. Na all disbocku pipul gather contribute to di roadmap.

Di Permanent Secretary of di Ministry, Bashir Nura Alkali, follow tok say after dis launch of di Roadmap, say Ministry go organise trainings and workshops for all di stakeholders.
“Effort bocku wey we don put inside dis strategy, so we go need pipul wey sabi the work wella to help implement am to di fullest,” na im be wetin Permanent Secretary use mouth tok.

Ogbonge ogas wey gather dey di event include the Secretary to the Government of the Federation, wey pesin represent am, Di Minister of Information and Culture, di Minister of Finance and Budget Planning, di Minister of Trade and Investment, di Minister of State, Mines and Steel Development, Senate and House Committee Chairmen on Poverty Alleviation; IDPs and Refugees, di representative of Borno State Governor, International Partners and Donors, members of di diplomatic corps, among plenti-plenti oga-madam dem.


Rhoda Ishaku Iliya
Deputy Director (Information)
February 14, 2022