N5,000 Monthly Allawe For di 2m Nigerians To Start June – FG

0
397
Share the Story

Federal gofment don announce say two million Nigerians go soon start to dey collect five-five thousand Naira from June as basic cash transfer under di National Cash Transfer Programme.

Di Federal Gofment go dey pay N5,000 each from inside N20 billion wey dem been budget to give
beneficiaries, especially poor pipul wey no get anything.

For inside di March document on di strategic roadmap and activity of di Federal Ministry of Humanitarian Affairs, Disaster Management and Social Development, di document tok say di number of beneficiaries don dey increase.

Di document follow tok say for 2018, about 19 state na im dem cover for dis National Cash Transfer Programme, and e come increase to 24 state in 2019, come follow increase again to 36 states and di Federal Capital Territory in 2022. Altogether, na 1.6 million pipul dey benefit.

Even sef, di Minister of Humanitarian Affairs, Disaster Management and Social Development, Sadiya Farouq tok say di document show say di number go still increase in June.

“School retention, good water and hygiene conditions for deir house and environment,”
Madam Farouq tok say her ministry na im designed wetin dem dey call ‘social register’ wey dem call am Rapid Response Register to use record poor workers wey be say na daily wage dem dey collect for their petty work. Dem find all dis pipul for different-different town and city, especially di ones wey really suffer during di COVID-19 lockdown.
“Up till now, out of di one million beneficiaries wey di gofment been target, we don pay N5,000
to 850,000 beneficiaries digitally through di Nigeria Inter-bank Settlement System wey dey validated all di account before payment.

“We go pay 150,000 by di end of April. All dis beneficiaries go collect six months of support in cash.”

Di ministry tok say according to dis National Social Register, 46 million pipul for all di 36 states and the FCT, gada from about 11 million household na im dem don registere as of 2022.

E come follow tok say di N-Power volunteer scheme don provide temporary job opportunity for 498,602 graduate for inside Batch A and B while 450,000 graduate under Batch C,
Stream 1 don dey engaged.
Di ministry come tok say dem don dey gather anoda 390,000 pipul for Batch C Stream 2 and say dem don get presidential approval to add another 1 million beneficiaries.