BORNO IDP FIRE CAMP HUMANITARIAN MINISTER SYMPATHIZE WIT VICTIMS

0
767
Share the Story

Di Honourable Minister of Humanitarian Affairs, Disaster Management and Social Development, Sadiya Umar Farouq, don express sorrow for di pipol wey lose life  and property for di fire wey hapun at Muna El- Badawy, Internally Displaced Persons ( IDP) Camp,  for Maiduguri, Borno State.

For inside the paper wey Permanent Secretary of di Ministry, Bashir Nura Alkali write, he talk say de Minister don send i-sympathy to de family of pipol wey dier persons die for de fire outbreak.

Madam Minister tok say from report wey reach-am edon confam say many pipol die, and over 3,000 houses don kaput, wey come make plenti-plenti families nor get where to stay again because of dis fire.

She follow tok say, dis frequent fire outbreak wey dey hapun for IDP Camps don dey worry gofment, say Federal Gofment wit oda agencies don join togeda to find lasting solution to dis problem for sake of to safeguard life and property of Internally Displaced Pipul dem.

In di meanwhile, di Minister tok say e-don direct di National Emergency Management Agency  make dem carry relief materials quick-quick to di victims for di camp. And say as dat one dey go on, dem go begin find out wetin cause di fire and also di level of damage.”

Madam Farouq don urge all di pipul wey dey live for inside IDP Camps for our Naija country to dey very safety conscious so dat dis kain fire disaster no go hapun again.

Signed,

Rhoda IshakuIliya

Deputy Director Information

Social Plus Africa Pidgin English

Translation: Maymunah Zubair