Umar Farouq don Sympathize Wit Explosion victims. – Follow condemn illegal oil bunkering

0
440
Share the Story

Di Minister of Humanitarian Affairs, Disaster Management and Social Development Sadiya Umar Farouq don condemn di latest explosion wey happen for Lagos and Imo state in less than one week. She tok say even as di incident dey occur well-well, dem for still fit avoid am.

Di Minister sympathise wit di gofment and pipule of Imo, Lagos and Ogun state about di deadly explosion wey occur for di illegal oil refining site on Friday night. Di explosion kill many-many pipule for Abaezi forest wey dey for Ohaji-Egbema Local Gofment Area of Imo State.

Also, on Thursday, tanker wey carry 45,000 litres of PMS crash and all di content thro way all over Lagos and Ogun State along Lagos – Ibadan Expressway. One man sef die for dis accident.

Umar Farouq don advise say make pipule wey carry substance wey fit easily catch fire dem dey on top our road wit. She come follow tok say pipule wey dey involve in illegal bunkering of petrol na journey of no return for di pesin be dat.

“Dis explosions wey dey repeat im self for Lagos and Imo states dey very unfortunate but e for still dey avoidable. We need to dey regularly dey tok am well well because di result of dis acts na im lead to di death of many pipule so.

“Illegal bunkering of petroleum products na punishable offense under di law, so therefore, di pipule wey run dis wicked act need to face di music wit full punishment of di law.
“I wan sincerely sympathize wit di family of all di victims and I pray say dem go all rest in peace.
“I wan also beg country-pipule especially di youths say make dem commot hand from illegal bunkering of petroleum products in di area”.

Meanwhile, dem don immediately start rescue operations to remove body of victims wey burn during di explosion for Imo state, so tey dem no fit recognize dem again. About six vehicles also follow burn for di incident.

NNEKA IKEM ANIBEZE
SA MEDIA
23-04-2022