WFP-FMHADMSD-ECOWAS JOINT TORI COMOT

0
466
Share the Story

17 March 2022

NIGERIA, ECOWAS SUPPORT WFP’s FOOD AND NUTRITION ASSISTANCE TO VULNERABLE FAMILIES WIT IM US$1M IN 2021

ABUJA – Di United Nations World Food Programme (WFP) don get di US$1 million moni in 2021 from di Gofment of Nigeria as part of ECOWAS humanitarian assistance to di Nigerian Gofment for d pupul wey d cata-cata bege for di wahala wey dey happun for North West and North East Nigeria.

Di moni from ECOWAS been dey granted to the gofment of Nigeria from di ECOWAS Regional Stabilization Fund. Di Gofment of Nigeria come join with WFP in Nigeria to use di moni take comot hungeri for Katsina, Zamfara and Borno states.

Di programme been dey target 840 households (some 4,196 persons) for Zamfara, Katsina and Borno states wey get food wahala, we go dey helep dem with food. Di beneficiaries go dey collect average cash transfer of NGN 27,000 in dier prepaid bank cards or WFP SCOPE cards every month to take buy food wey dem like from local market. Dem encourage beneficiaries to buy different-different local food from market. Dis cash transfer come get additional advantage of stimulating local markets as well as agricultural production.

To prevent serious malnutrition in children for di first 1,000 days of dem life, di programme come follow provide nutrition to dey helep children from 6-23 months old and to pregnant women as well as women wey dey breastfeed vulnerable and food wahala households. Some 14,070 children and 1,932 pregnant/breastfeeding women come get specialized nutritious food for di three (3) project states.

In addition to all dis, WFP dey use di ECOWAS donation to helep household wey dey for kata-kata wahala states of Borno, Adamawa, Yobe and Katsina tanda gidigba. Di project go also provide milling machines as well as training support to 603 returnees from Cameroon and displaced rural women to support dem to generate some income to take sustain dem livelihoods.

Quotes

Honorable Minister Sadiya Farouq, Federal Ministry of Humanitarian Affairs, Disaster Management and Social Development:

“Dis project don provide di FMHADMSD better-better way to dey showcase im best practice of partnership and collaborate in how dem dey take deliver humanitarian intervention. E don follow advance di effort of di Nigerian Gofment to touch di life of plenti-plenti Nigerians wey dey vulnerable situations.”

ECOWAS: Dr. Siga Fatima Jagne, Commissioner for Social Affairs and Gender, ECOWAS Commission:

“In line with di humanitarian mandate of di ECOWAS Commission also with di response to di Decision of di Fiftieth Ordinary Session of di Authority of Heads of State and Gofment of December 17, 2016, to assist population in North East Nigeria wey dey affected by terrorism, di ECOWAS Commission gather join with Gofment of Nigeria and di World Food Programme dey provide humanitarian support to our population for Nigeria wey dey in need, and e go continue to build di resilience of our people to bridge di gap wey dey between humanitarian work and development across di West African region for a prosperous ECOWAS Community.”

WFP:
Ronald Sibanda, WFP Representative and Country Director a.i.:

“Di contribution of Gofment of Nigeria, through ECOWAS, been come at a very critical point as country people dey suffer impact of wahala and climate change wey dey contribute to hunger for di country. Inside dis affected states, plenty wahala, climate shocks, high food prices don really undermine people’s ability to feed them sef. WFP really dey happi for dis contribution wey dey support di effort to continue to dey provide life-saving food and nutrition as well as assistance to people wey dey in need for states wahala of im states”.

Di United Nations World Food Programme na im be di ogbonge humanitarian organization for dis world wey dey save lives incase of emergency, and e dey also give food assistance. All dis things na im dey build road to peace, stability and prosperity for im country people wey dey recover from wahala, disaster, and di impact of climate change. Follow dem for Instagram @fmhds_ng and @worldfoodprogramme.

For informate, abeg call im
Halima Oyelade, FMHADMSD/ Abuja. Mob. +234 806 33 90 420. hoyelade@gmail.com
Godfrey Alozie, ECOWAS, Abuja. Mob. +234 803 701 1515. galozie@ecowas.int
Kelechi Onyemaobi, WFP/ Abuja. Mob. +234 902 486 7649. kelechi.onyemaobi@wfp.org