UMAR FAROUQ DON CONDEMN ATTACK ON 5 COMMUNITIES IN PLATEAU

0
436
Share the Story

Di Minister of Humanitarian Affairs, Disaster Management and Social Development Sadiya Umar Farouq don really condemn di attacks wey happen to five communities for Plateau state, she tok say e dey satanic.

Umar Farouq sympathized with di state government and victims of di armed banditry attacks wey happen for Garga District of Kanam Local Gofment Area for Plateau State. She tok say di violence wey dis bandit unleashed on innocent citizens especially as dem dey do Ramadan Fasting na very evil thing.

Di Minister don announced say relief materials dey on the way to di victims.
She don direct sharp-sharp deployment of relief materials including food, water, blankets and sleeping nets to di displaced victims wey dey seek refuge for Garga Central primary school, Kanam Local Government Area of Plateau State.

Na five communities including Kyaram, Gyambau, Dungur, Kukawa, Shuwaka villages under Garga District na im bandits attack on Monday while many people na im die for di palaver.

Di National Emergency Management Agency wey dey under di Ministry plus including SEMA, Joint Military Task Force, Community Leaders, Local Government Council Members and di Media don already dey Plateau state to use korokoro eye take see di level of destruction and advice di agency appropriately.

Di Coordinator of NEMA North Central Zonal office Jos, Mr Eugene Nyelong na im lead di team wey go there. Him confirm say dem don start profiling and assessment of victims.

According to Nyelong, di assessment don start since Tuesday April 12, 2022, and many pipule die, and many m others lose property as well.

Di numba of Internally Displaced Persons (IDPs) don pass 4800, and na mostly women and children.

The local Gofment Health Department through di dispensary in Garga Town dey offer small-small medical support to all di displaced persons, di Director General of NEMA Ahmed Mustapha Habib sef dey work on how to take deliver sharp-sharp delivery of emergency humanitarian support before dem go start full intervention.

NNEKA IKEM ANIBEZE
SA MEDIA
13-04-2022