Di Minister of Humanitarian Affairs, Disaster Management and Social Development Sadiya Umar Farouq don send im condolence message to all di family and victim of di Abuja-Kaduna train wey unknown gunmen attack on Monday for Dutse Forest, Chikun Local Government Area of Kaduna State.
Di Minister, been directed sharp-sharp deployment of di NEMA Northwest Zonal Office team to go di place wey di train attack been hapun and to check on di victims; she tok say dis incident dey very horrific.
โI dey send my heartfelt condolences to di family of di pipul wey lose dier lives for dis attack. I pray say God go console and strengthen dem at dis time of grief. I de also pray for di wounded and hospitalized pesins wey sustain injuries, I pray say dem go recover quick-quickโ.
Di National Emergency Management Agency Zonal Coordinator Abbani Imam Garki na im lead im team go visit eleven victims wey dey receive treatment for St. Gerald’s Hospital for Kaduna. Dem refer eight victims to 44 Nigerian Army Reference Hospital, Kaduna. Anoda two of di victims wey sustain gunshot wound and fracture still dey hospitalized.
Di management of di hospital follow confam dem get twenty-five (25) victims on admission wey gada get different-different injury.
One representative of di Chief Medical Officer of the 44 NARHK
hospital tok say some victims don already do surgery, while oda victims don collect treatment come dey under observation.
Kaduna State Emergency Management Agency don announce say make family of di victims try contact 09088923398 for inquiries or to provide information on passengers wey travel with di Abuja-Kaduna train on March 28, 2022.
๐๐ฐ๐ค๐ช๐ข๐ญ ๐๐ญ๐ถ๐ด ๐๐ง๐ณ๐ช๐ค๐ข ๐๐ช๐ฅ๐จ๐ช๐ฏ
๐๐ณ๐ข๐ฏ๐ด๐ญ๐ข๐ต๐ช๐ฐ๐ฏ ๐ฃ๐บ ๐๐ข๐บ๐ฎ๐ถ๐ฏ๐ข๐ฉ ๐ก๐ถ๐ฃ๐ข๐ช๐ณ