FORUM ON DEVELOPMENT AND RECOVERY OF LAKE CHAD DON MAPS OUT STRATEGIES FOR STABILITY IN THE REGION

0

A two-day Forum on di Development and Recovery of the Lake Chad Basin Region just end for Abuja. For dis forum, dem call make everybody gada join hand to rebuild communities wey dey around di Lake Chad Region wey been dey affected by insurgency and oda humanitarian crises.

For di opening of di ‘Inaugural Forum on the Development of Lake Chad Basin’ wey hold on Monday for di International Conference Centre Abuja, Vice President, Prof Yemi Osinbajo tok say di Federal gofment go dey active to create policies wey go ginger di rebuilding of di region.

Prof. Osinbajo hail di Minister of Humanitarian Affairs, Disaster Management and Social Development Sadiya Umar Farouq, di North East Development Commission, di Lake Chad Basin Commission and oda stakeholders for all deir commitment and contribution to try recover Lake Chad Region, him follow tok say dem go transmit all di results and recommendations of di forum to di different-different gofments to guide dem for di policy making and strategic positions wey dem go want take as e dey relate to that region and how e go develop.

“I wan assure all our partners say government dey very committed to work with una so that wd go fit see sustainable, peaceful and lively region. I follow wan to assure una say we dey very determine to address di crisis and to rebuild di livelihood of people wey don. dey affected because of all di humanitarian crisis wey dey happen for di region. I dey very sure say na di same ginger wey Nigeria get na in be di same wit di gofment of Cameroon, Chad and Niger as them sef dey here,

“Di Federal gofment of Nigeria go dey active to make sure say we dey helep to improve di life of we brodas and sistas wey dey dis four countries”, na wetin di Vice President tok.

For di same forum, Minister Sadiya Umar Farouq been done estimate say about 23 million civilians wey dey affected by Boko Haram insurgency been dey waka up and down across di four countries wey border di Lake Chad Basin for di last ten years.

Di Minister wey di outgone Permanent Secretary Mr Bashir Nura Alkali been represent tok say di main thing wey dis inaugural forum wan gain na to capitalise on all di success of di military operations of di Nigerian Armed forces, di Multinational Joint Task Force (MNJTF) as well as militaries of all LCB countries.

She tok say “To avoid another humanitarian disaster, our intention na to develop solution wey go address di challenge wey pupil dey face, like climate change and conflict, and to helep support economic recovery, repair di social contract and to try address di needs of women, youth and the most vulnerable wey dey Lake Chad region.

“Dis forum really come for very important important time as we dey plan to extend pass platform wey dey coordinate alone, we dey also try to achieve concrete joint advocacy actions, and to contribute to di orderly and humane management of reintegration systems and to assist to find practical solutions for di Lake Chad Basin”.

For di second day of di Forum, dem been get technical workshop about ‘Solutions for climate resilience in the Lake Chad Region’, ‘Supporting Local Gofnance in the Lake Chad Region’ and ‘Engaging Citizens, Women and Youths and Building Social Cohesion in the Lake Chad Region.

The Forum been dey attended by top Oga-madam dem, gofment officials of Nigeria, Chad, Cameroon and Niger Republic, Ministers, Governors, Ambassadors and High Commissioners, representatives of Security Agencies, gofment agencies, NGOs, Civil Society Organizations and oda distinguished guests.

NNEKA IKEM ANIBEZE
SA MEDIA
12-04-2022

Sadiya and impacts of FG’s humanitarian policies

0

Di Federal Ministry Of Humanitarian Affairs, Disaster Management And Social Development, don make sure say all di welfare policy of di gofment dey reach countri pipule. But di thing wey dey sweet belle pass na say President Muhammadu Buhari choose Sadiya Umar Farouq to dey look after di Ministry, wey everybody don hail as very good move, ERE-EBI AGEDAH IMISI come look the matta, and the impacts of all di work wey dem don do.

Dem create di Federal Ministry Of Humanitarian Affairs, Disaster Management And Social Development because of serious need for di administration of President Muhammadu to get how e go take dey give back, dey harmonize, and to dey coordinate all di humanitarian and social interventions wey gofment dey do.

As di country dey faced different-different forms of crisis, insurgency for Northeast, bandit for Northwest, inter-community conflict for Middle Belt, kidnapping, farmer/herders’ conflict, fire outbreak, and many other things wey follow join all of dis wahala na im result in dis call for humanitarian aid.

Dis Ministry wey dem create in 2019 to dey make sure say all di welfare policy of di gofment dey reach all di countri-pipule wey dey suffer for our communities dey very timely, on top of how people don hail President Muhammadu Buhari as him choose Sadiya Umar Farouq to dey oversee and coordinate di Ministry, say na idea wey make sense wella.

Di Minister dey very hardworking and she no dey like some other top government official because she dey ever ready to meet with stakeholders, especially the media, MDAs, CSOs and NGOs because she dey proud to show all di achievements since she start as di pioneer Minister in charge of di ministry. Madam minister really get plenty project and plans wey she dey always reveal wey make her dey very popular. Nobody go doubt am if you call her di “star girl” of President Muhammadu Buhari gofment.

Na as she begin run di Ministry na im country start to dey really ensure say countri-people wey dey internally displaced because of security challenges in parts of the country dey get fair treatment, small by small cone dey help dem comot from all di years of neglect, abandonment wey some bad citizens dey chop all di resources wey government make available for dem. But as dis new Oga-madam come, she really shake everywhere; From Borno, Adamawa, Zamfara, Yobe, Benue and everywhere, as e be say she be mother with overflowing milk of kindness, she really make sure dis category of citizens wey find their self for situation wey no be their making, say dem dey really take care of dem above average.

Di Minister Don also announce many program wey go bring lasting succour to IDPs for di County, sat na why She launch di National Policy on IDP. Dis policy na im dem go take design the way wey dem go work out how dem go prevent and protect citizens and foreigners alike from any kind of internal displacement, and also to dey offer assistance and protection during displacement.

Na for inside dis same policy document na im di road map to make sure say do IDPs go fit get rehabilitation, return, reintegration and relocation after displacement. According to di Minister, all di principle wey dey guide humanitarian assistance and implementation of durable solutions in situations of internal displacement in Nigeria dey inside dis policy too.

Because of di hardwork of di Minister, the federal government don implement di National Social Investment Programme, NSIP wey be ogbonge social protection programme for di history of Nigeria and even beyond. Di programme really bring hope to bocku-bocku families wey I’m don help to reduce poverty rate, improve standard of living, and to give young-young people access to empowerment, plus including education, health care services, and to help reduce malnutrition wey dey catch children wey dey school, come follow dey provide small-small credit facility for small and medium scale business.

Di N-Power programme, di National Home-Grown School Feeding Nationwide, the Conditional Cash Transfer plus including di Gofment Enterprise and Empowerment Programme, GEEP, all of dem na social intervention schemes wey Nigerians don benefit from under di National Social Investment Programme, NSIP.

For inside 2020 alone, di Ministry dey very successfully for di exit of 500,000 Batch A and B N-Power beneficiaries and e come process over 6.4 million applications for Batch C. E giid make everybody know say, for inside Batche A & B, a total of 109,823 beneficiaries done set up business for their communities; na di impact and importance of di N-Power programme and di Ministry, na im be dat.

For dis time now for inside Batch C, Stream 1, nothing less than 510,000 young-young people for all around di country don enrol and dem don dey benefit from di programme, untop dat one, additional 490,000 beneficiaries go still enrol after President don approve to increase di number to one million. As di Minister tok am for di last stakeholders meeting, wetin e mean be say at least one million young people go gain skills for different trade or job in di next one year, through job exposure, training and experience, so dat dem go fit start their own businesses or get jobs based on di experience wey dem gain for di programme.

For Nigeria, almost all di communities get one mobile moni agent or the other, dis thing don really helped to bring financial service to di doorsteps of country-people for rural area. E come also help engage young people meaningfully, thanks to di mobile money agency programme of di ministry. Di programme na nationwide intervention under di N-Power programme wey train and equip 1,850 agents, come amount to 50 agents for each state and empower dem with di tools, including Point of Sales ( we dem dey call POS) Machines with a start-up amount of N20,000 preloaded, fingerprint scanner, plastic chairs, plastic table, outdoor umbrella and hardcover ledger for proper accounting.

Anoda important one na di National Home-Grown School Feeding Programme wey dey fully operational for 35 states and di FCT, arrangements to add Bayelsa don already dey advanced stage. Dis program na huge relief on parents and guardians and na massive incentive for school enrollment. Dis programme wey dem introduce in 2016, di programme dey provide one free nutritious meal to pikin wey dey primary 1-3 across public schools nationwide. Na which pikin dem go need force to school wey no go go because of full stomach? For di moment, almost 10 million children in 54, 619 schools don dey benefit from dis creative programme. Apart from that, about 120,000 cooks, and about 100,000 smallholder farmers and numerous aggregators dey also benefit for di programme across di country. E never tey wey Ministry review di cost to feed each child from N70 to N100 per meal.

Dis minister don really hold Ministry well for di past three years don really record many milestones and country-people dey very thankful to not only to Mrs. Sadiya Umar Farouq and her wonderful team in di ministry but the President, Muhammadu Buhari and di federal gofment.

Na true say all dis intervention as e bocku so, no go ever dey enough to highlight work wey di ministry don record in a short period of time, but e dey important to note say Gofment Enterprise and Empowerment Programme, GEEP dey try to address di challenges of credit and financial inclusion for over 37 million country-pipule wey no too get resources but wey dey active for business, but dem never had get di opportunity to get loan. Dis program so far don provide loan of N10,000 and N300,000 to about 2.3 million beneficiary traders, enterprising young people, agricultural workers and other micro-service providers wey dey under flagship programmes like TraderMoni, MarketMoni and FarmerMoni wey dey directly supervise by office of di Vice President, Professor Yemi Osinbajo.

Di impact dey very amazing while di testimony dey very encouraging. Di TraderMoni dey cater to poor and enterprising youths, while MarketMoni dey cater to poor and enterprising women. Di two dey disburse N50,000 per beneficiary. Poor and rural farmers dey captured under FarmerMoni, and the loan amount na N300,000. GEEP dey also increase financial inclusion for dis people through addition to formal financial system of banking.

True true e no go bad to hope say di days wey dey come get much promise for country-pipul people as di ministry dey on ground to sustain social intervention programs and to broaden to spread far to make sure say more Nigerians dey economically empowered, im vision na to improved living standard for environment wey dey safe and secure because dis na di vision of di federal gofment for all citizens.

𝗞𝗢𝗚𝗜 𝗛𝗢𝗨𝗦𝗘 𝗢𝗙 𝗥𝗘𝗣𝗦 𝗔𝗦𝗣𝗜𝗥𝗔𝗡𝗧 𝗔𝗟𝗛. 𝗪𝗔𝗦𝗜𝗨 𝗜𝗦𝗦𝗔𝗛 𝗖𝗔𝗟𝗟𝗦 𝗙𝗢𝗥 𝗖𝗢𝗢𝗣𝗘𝗥𝗔𝗧𝗜𝗢𝗡 𝗔𝗠𝗢𝗡𝗚 𝗣𝗔𝗥𝗧𝗬 𝗠𝗘𝗠𝗕𝗘𝗥𝗦

0

12𝘵𝘩 𝘈𝘱𝘳𝘪𝘭, 2022

House of Representatives aspirant for the Okehi/Adavi Constituency of Kogi State, Alh. Abdulwasiu Issah and Convener of Wasiu Issah Network (WIN), has called members of the All Progressives Congress to work together in harmony to deliver on its mandate to the people.

Alh. Issah made the remarks as support for his aspiration gathers momentum among people of the grassroots of his constituency. He stated that it was pertinent for party stalwarts, officials, delegates and supporters alike to band together as the nation inches closer to another election year.

“We are at the last lap of this dispensation and we will be heralding a new one soon. It is of utmost importance that APC is seen to be devoid of conflict, as only then can we garner the support and confidence of the electorates, to install a new government, for the good of the people,” he said.

The aspirant, who is a popular favourite among his people, is vying for the Okehi/Adavi Constituency House of Representatives seat. Well known for his grassroots philanthropy and community development contributions, Alh. Abdulwasiu has opined that his personal and public mandate will always be unalloyed loyalty, and total service to the people.

Signed,
Wasiu Issah Network,
Media and Publicity Team.

NCPC BOSS HARPS ON READING CULTURE BY NIGERIANS

0

The Executive Secretary Nigerian Christian Pilgrim Commission, Rev.Dr. Yakubu Pam has stressed the need for Nigerians to go back to their reading culture which they are known for . He made this assertion while playing host to the Nigerian Pilot Newspaper Management in his office at the NCPC corporate headquarters in Abuja, on 7th April, 2022.
Rev. Dr.Pam disclosed that the society gets informed about happenings around the world through the media. He further explained that newspaper readers in the past were classified as serious citizens of the country. But to his dismay, Nigerians no longer read newspapers which was the means of disseminating information in those days, according to him, ‘’we are in a generation of mobile phone users who gets their information easily now on social media’’.
The NCPC scribe urged Nigerians to reawaken the reading of newspapers to help their reading culture.


The Executive secretary intimated that the Commission cannot do without the media because the pilgrims need information from the Commission on a daily basis, and as such, it is the work of the print, electronic and the social media to relate such information to the public. In his words, ‘’we need to work together with them for the sake of pilgrimage’’.
Earlier, the leader of the delegation Mr. Chuks Ohuegbe who is the Director of Publication of the Nigerian Pilot Newspaper said,” they came to forge a relationship with the Commission”
He intimated that the Nigerian Pilot Newspaper has been on the news stand for over 15 years; hence they have come to exchange ideas with the leadership of the Commission. According to him, ‘’the Newspaper is open to all segment of the society’’.
Mr. Ohuegbe informed that the Newspaper runs a religious page on Friday which is open to churches and organizations such as NCPC to generate the content for publication; he therefore said that the Nigerian Pilot would be willing to make the newspaper available to the Commission as part of their contribution to the great work of the Executive Secretary by showcasing the activities of the Commission to the public.

Godiya Mathew
Information Officer 1
NCPC Media & Public Relations

KOGI MIREMCO BOSS CALLS FOR PROPER RE-ORIENTATION OF MINING COMMUNITIES

0

The Chairman of the Mineral Resources and Environmental Management Committee, Kogi State Chapter, Hajiya Hassiat Ozavize Suleiman has charged policy makers of the Mining Sector to embark on nationwide sensitization to re-educate local host communities

The charge was made in a meeting convened at the instance of the Honourable Minister of Mines and Steel Development, Arc. Olamilekan Adegbite, to discuss and profer amicable resolution to the ongoing dispute between the people of Ika Community, Sybstec Nigeria Limited and Zuma 828 Coal Limited.

The meeting which was chaired by the Director – General of the Mines Cadastre Office, Engr. Simon Nkom was called as a result of lingering tensions between Ika Community, Sybstec Nigeria Ltd and Zuma 828 Coal Ltd, where claims were made that there is an overlap between the title area of the mining companies, frustration of the Community Development Agreement signing by the host community, claims that Zuma 828 Coal Ltd got their consent from unknown sources, among others.

In her remarks, Hajia Hassiat Suleiman pointed out that it is now a common occurrence where host communities claim that they do not know a particular mining operator even after the said operator may have been operating for a while in that community, citing a similar occurrence between Otih 3 Community and Mosra Enerji Ltd.
Speaking further, Hajia Suleiman reminded the gathering of KOGI MIREMCO’s efforts and the position of the Committee regarding the case till date.

The meeting ended with every party involved agreeing to accept any position MCO proposes provided it would engender peace and development in the area.

In attendance alongside the DG MCO and Chairman Kogi MIREMCO, were the Executive Chairman of Ankpa Local Government Area, the Onu of Ankpa, HRH Umoru Zekeri, representatives of Sybstec Nigeria Ltd and Zuma 828 Coal Ltd, directors of Mines Inspectorate, Mines Environmental Compliance and Legal Departments of the Ministry of Mines and Steel Development.

Abuja, Wednesday, 6th April, 2022.

By Maymunah Zubair

N5,000 Monthly Allawe For di 2m Nigerians To Start June – FG

0

Federal gofment don announce say two million Nigerians go soon start to dey collect five-five thousand Naira from June as basic cash transfer under di National Cash Transfer Programme.

Di Federal Gofment go dey pay N5,000 each from inside N20 billion wey dem been budget to give
beneficiaries, especially poor pipul wey no get anything.

For inside di March document on di strategic roadmap and activity of di Federal Ministry of Humanitarian Affairs, Disaster Management and Social Development, di document tok say di number of beneficiaries don dey increase.

Di document follow tok say for 2018, about 19 state na im dem cover for dis National Cash Transfer Programme, and e come increase to 24 state in 2019, come follow increase again to 36 states and di Federal Capital Territory in 2022. Altogether, na 1.6 million pipul dey benefit.

Even sef, di Minister of Humanitarian Affairs, Disaster Management and Social Development, Sadiya Farouq tok say di document show say di number go still increase in June.

“School retention, good water and hygiene conditions for deir house and environment,”
Madam Farouq tok say her ministry na im designed wetin dem dey call ‘social register’ wey dem call am Rapid Response Register to use record poor workers wey be say na daily wage dem dey collect for their petty work. Dem find all dis pipul for different-different town and city, especially di ones wey really suffer during di COVID-19 lockdown.
“Up till now, out of di one million beneficiaries wey di gofment been target, we don pay N5,000
to 850,000 beneficiaries digitally through di Nigeria Inter-bank Settlement System wey dey validated all di account before payment.

“We go pay 150,000 by di end of April. All dis beneficiaries go collect six months of support in cash.”

Di ministry tok say according to dis National Social Register, 46 million pipul for all di 36 states and the FCT, gada from about 11 million household na im dem don registere as of 2022.

E come follow tok say di N-Power volunteer scheme don provide temporary job opportunity for 498,602 graduate for inside Batch A and B while 450,000 graduate under Batch C,
Stream 1 don dey engaged.
Di ministry come tok say dem don dey gather anoda 390,000 pipul for Batch C Stream 2 and say dem don get presidential approval to add another 1 million beneficiaries.

FG DON ENGAGE 98,000 BENEFICIARIES FOR GEEP 2.0 PROGRAMME

0

Di Ministry of Humanitarian Affairs, Disaster Management and Social Development don concluded plans to roll out di Gofment Enterprise and Empowerment Programme GEEP 2.0 for all di 36 states and the Federal Capital Territory.
Dis na afta di final verification of Phase 1 applicants wey been qualify wey dem select to benefit from small loans ranging from N50,000 to N300,000.

Di Minister Sadiya Umar Farouq tok say all beneficiaries of GEEP 2.0 go collect congratulation and sensitization text message wey go also tell dem say dem don qualify and di message go also sound am well-well say dis empowerment program na loan, no be grant.

“All di beneficiaries wey qualify go soon receive their disbursement alert. We wan also remind all di beneficiaries wey qualify say this na loan wey una go fit pay back without interest. No be grant or free money from gofment oh. Na soft interest-free loan wey una must pay back 9 months”.

Minister Umar Farouq come also announce say di Ministry dey plan rollout di program all around di country, na afta dis part na im dem go start the biodata part.

Dis GEEP 2.0 na loan scheme wey di Federal Gofment design to provide moni and finances wey go fit go round to many poor pipul as well as pipul wey get disability and oda grassroot pipul wey dey really struggle, di scheme dey under dis three main di main schemes: Market Moni, Trader Moni and Farmer Moni.

Trader moni na for youth of between 18-40 years wey no get any means of survival like under-privileged and marginalized youths. Dis scheme go provide loans of N50,000 while Market Moni dey take under-privileged and marginalized women between 18-55 years like Widows, divorcees amongst other vulnerable groups. They get interest-free loans of N50,000 payable within 6-9 months.

Farmer Moni na for Nigerian farmers wit age between 18-55 years wey dey for rural area wey dey operate in di agricultural space. Dem go provide beneficiaries with loans of up to N300,000 for farming input. Dis scheme get 12 months including 3 months moratorium and 9 months repayment period.

NNEKA IKEM ANIBEZE
SA MEDIA
06-04-2023

Abuja-Kaduna Train Attack: Humanitarian Minister come dey pity Wit d Victims

0

Di Minister of Humanitarian Affairs, Disaster Management and Social Development Sadiya Umar Farouq don send im condolence message to all di family and victim of di Abuja-Kaduna train wey unknown gunmen attack on Monday for Dutse Forest, Chikun Local Government Area of Kaduna State.

Di Minister, been directed sharp-sharp deployment of di NEMA Northwest Zonal Office team to go di place wey di train attack been hapun and to check on di victims; she tok say dis incident dey very horrific.

“I dey send my heartfelt condolences to di family of di pipul wey lose dier lives for dis attack. I pray say God go console and strengthen dem at dis time of grief. I de also pray for di wounded and hospitalized pesins wey sustain injuries, I pray say dem go recover quick-quick”.

Di National Emergency Management Agency Zonal Coordinator Abbani Imam Garki na im lead im team go visit eleven victims wey dey receive treatment for St. Gerald’s Hospital for Kaduna. Dem refer eight victims to 44 Nigerian Army Reference Hospital, Kaduna. Anoda two of di victims wey sustain gunshot wound and fracture still dey hospitalized.
Di management of di hospital follow confam dem get twenty-five (25) victims on admission wey gada get different-different injury.

One representative of di Chief Medical Officer of the 44 NARHK
hospital tok say some victims don already do surgery, while oda victims don collect treatment come dey under observation.

Kaduna State Emergency Management Agency don announce say make family of di victims try contact 09088923398 for inquiries or to provide information on passengers wey travel with di Abuja-Kaduna train on March 28, 2022.

𝘚𝘰𝘤𝘪𝘢𝘭 𝘗𝘭𝘶𝘴 𝘈𝘧𝘳𝘪𝘤𝘢 𝘗𝘪𝘥𝘨𝘪𝘯

𝘛𝘳𝘢𝘯𝘴𝘭𝘢𝘵𝘪𝘰𝘯 𝘣𝘺 𝘔𝘢𝘺𝘮𝘶𝘯𝘢𝘩 𝘡𝘶𝘣𝘢𝘪𝘳

𝗞𝗢𝗚𝗜 𝗛𝗢𝗨𝗦𝗘 𝗢𝗙 𝗥𝗘𝗣𝗦 𝗔𝗦𝗣𝗜𝗥𝗔𝗡𝗧 𝗔𝗟𝗛. 𝗪𝗔𝗦𝗜𝗨 𝗜𝗦𝗦𝗔𝗛 𝗖𝗢𝗠𝗠𝗘𝗡𝗗𝗦 𝗚𝗢𝗩𝗘𝗥𝗡𝗢𝗥 𝗕𝗘𝗟𝗟𝗢, 𝗔𝗣𝗖 𝗖𝗛𝗜𝗘𝗙𝗧𝗔𝗜𝗡𝗦 𝗙𝗢𝗥 𝗦𝗨𝗖𝗖𝗘𝗦𝗦𝗙𝗨𝗟 𝗖𝗢𝗡𝗩𝗘𝗡𝗧𝗜𝗢𝗡

0

The Convener of Wasiu Issah Network (WIN) and House of Representatives aspirant for the Okehi/Adavi Constituency of Kogi State, Alh. Abdulwasiu Issah has commended Governor Yahaya Bello for a successful outing at the APC National Convention which held yesterday.

Alhaji Wasiu felicitated with the newly elected party officials as well, calling the entire process an exercise in true democracy. He noted that this was a testament to the party’s unity and sense of purpose. He opined that this and many more orderly electoral processes is what citizens should expect during the general election, come 2023.

In his remarks to press reps, Wasiu stated that he was most impressed with the orderliness and peaceful proceedings of all that were in attendance; instances of chaos or conflict were immediately quelled. This, he attributed to the dogged determination of Kogi State’s Governor Yahaya Bello, who served as the chairman of the security subcommittee.

“I must commend and congratulate His Excellency, Governor Yahaya Bello for a successful and peaceful convention today. Indeed he went over and beyond to see that all security apparatus were deployed to ensure a favorable and peaceful atmosphere for party stalwarts and supporters alike. This is not surprising, as His Excellency has consistently kept the peace and won numerous accolades as the most security conscious Governor in the country. This, more than anything, cements the numerous reasons why he should take on the mantle of President, come 2023,” he said.

Speaking further, the aspirant urged the incoming party officials to toe the line of their predecessors and avoid skirmishes and rancour within the party in order to keep a united APC. He appreciated President Muhammadu Buhari, as well as the prevailing of other elders in the party for keeping the peace up till this moment, and charged party leadership and officials to work in tandem to deliver on the mandate of the party in the coming election.

Signed,
Wasiu Issah Network (WIN)
Media and Publicity

FG DON APPROVE TRAINING OF 50,000 NON- GRADUATE N-POWER BENEFICIARIES

0

Di Federal Gofment don approve di engagement of four of im Agencies to train 50,000 Non-Graduate N-Power Beneficiaries.

Na for di Federal Executive Council wey hold on Wednesday, na im dem approve say make di National Institute of Transport Technology NITT, Industrial Training Fund ITF, National Institute for Hospitality and Tourism, Hydraulic Equipment Development Institute HEDI train di beneficiaries for 9 months.

Di Minister of Humanitarian Affairs, Disaster Management and Social Development Sadiya Umar Farouq tok say di ministry dey run di implementation of di National Social Investment Programme (NSIP) in line with im mandate to reduce poverty, and to increase social inclusion and youth empowerment.

“Dis N-Build dey under di N-Power cluster of programmes wey NSIP dey manage and e dey target unemployed non-graduates. Dis proposed training na continuation of N-Build training wey start in 2017 wit all di batch of N-Power trainees.

“Di Ministry don review di delivery process of di N-Build programme so dat we go fit confirm whether e dey helep wit di Job Creation/Poverty Reduction agenda of di Federal Gofment and note di capacity of the four existing professional vocational training Institutes wey di gofment set up with different mandates. Dem use care to choose dis Institutes in line wit di objective of di N-Power and e dey based on di capacity to train, assess, certify and guide candidates so dat dem go fit achieve di National Skills Qualifications (NSQs) of di N-Build Programme”.

The proposed training programme go be three (3)months of In-centre class training, six (6) months for apprenticeship, post Apprenticeship, mentorship with provision of Starter Packs and assessment wey go lead to di award of National Board for Technical Education (NBTE) Certification.

Di N-Build apprenticeship programme go dey coordinate across di 36 States and FCT and centres in almost 350 Local Gofment Areas.

Di National Institute for Hospitality and Tourism go provide professional and technical skills upgrade training programmes for di beneficiaries in Baking, Cooking/ catering, House- keeping and Mixology plus including all areas of Hospitality and Tourism, whether na directly or indirect aspect of hospitality, den, di Industrial Training Fund ITF go train beneficiaries in Electrical, Masonry, Plumbing and Carpentry.

Na di National Institute of Transport Technology NITT go handle di Training Services in Automobile and Agritech Tracks, while di Hydraulic Equipment Development Institute HEDI go empower beneficiaries in welding and Fabrication, Electrical Fittings and Plumbing.

SA MEDIA

24-03-2022